Thursday 5 June 2014

FABREGAS: CHELSEA,ARSENAL OR MANCHESTER UNITED? #fabregaswhere

  
   Tori wey dey reach our side say Manchester United,Chelsea and Arsenal dey pursue Fabregas say dem wan buy am oo. We even hear say Chelsea use Jet bring am come them club say make dem do medical test for am.                           
 Manchester united say dem wan buy am for £34m,Chelsea say£32m and Arsenal say £29m. Fabregas wey be 27 years wey Barcelona buy for 2011 for £35m, from Arsenal neva do the kin work Barcelona expect of am. Barcelona don say na person wey drop plenty money pass dem go sell to o..Where you think say Fabregas go carry hin boot go?

Wednesday 4 June 2014

CARRY CHARM,BIBLE,QURAN GO THERE! #carrycharmgo

   
U don dey fear? Calm down make u drink small water for there. No cause for alarm. Well,Ogbeni Rauf Aregbesola wey be Osun State Governor ha hin talk say make Una carry Charm,Bible and quran go vote o.                                              
    Na when he go do Campaign for Ikire on Tuesday (3/6/2014)hin talk this one o. Shebi una know say na August 9 dem go do Governor election for Osun..If u no know before,u don know now o.            
    He tell dem say make dem no gree for anybody to do dem vote anyhow o. Say dem know say PDP wan use wicked method take rig d election.                   
    He say make d people stay with them vote ni oo. Say if dem want dey enjoy wetin APC dey do for d state, Say make dem no gree for mago mago o.

NEW CBN GOVERNOR ENTA OFFICE #newcbngovernorentaoffice

Oga Godwin Emefiele wey be New CBN Governor on Monday Chuk eye enta CBN Headquarters for Monday. T  his man wey be Former Managing Director for Zenith Bank don dey inside Bank mata for like 20 years o.                                           
 Oga Godwin wey be say get Certificate for Nsukka and some schools for Obodo Oyinbo go do talk talk for Thursday o. Inside dis talk talk with Media people, he go tell everybody how he wan take manage Naija Economy o, How he go take help Naija save plenty money and How He go help Naija money get confam value near dem dollar,pounds and Euro dem.

LASU STUDENTS SCATTER GROUND #lasustudentsscatterground

   
Na yesterday(Tuesday)this one shele o. Students of Lasu say dem wan do 'we no go gree' waka reach Ikeja and Oshodi from dem school o. Dem say dem school money too cost o. As d waka begin, na so some of dem begin dey spoil tinz for area. Dem dey even disturb people wey dey drive motor and person wey dey waka oo. Na so people for area(Bolade) call Police.                                                    
    When Police reach dere,dem begin dey shoot tear gas and confam bullet o. Up to 10 students na hin faint oo. Dem even say dem arrest reach 20 students dem. Person wey be Presido for student mata for d skul-Nurudeen Yusuf say dem no spoil anybody Property ooo. Dem say na peace peace dem dey do before dem Olopa people con use gun spoil everytin oo.

I NO FOLLOW OBASANJO FIGHT AGAIN O #inofollowobjfight

    
Na Oga Atiku Abubakar talk this one o. He talk am yesterday when people wey b dem Youth Oga for North come see am. Na these people help Obasanjo and Atiku Settle dem fight o.                                
     This fight wey shele because Obasanjo wan go third-term and Atiku wan be President don start tay tay. Oga Atiku say hin thank dem well well. Atiku talk again say make Oga Federal Government do sumtin fast about dem Boko Haram o before dem spoil our country

FEDERAL GOVERNMENT SEE OJUJU WORKER DEM #demojujuworkers

Oga Federal Government say dem see 56,000 Ojuju worker wey dey collect money wey pass 120billion. Dem say Thank God dem see am o,say money go just go like that shaa. Na wen dem dey do Democracy(May 29) Oga presido bring one book wey dey talk about all the tin Federal Government do from 2013-2014 o.Kai. Thank God dem see this kin tin o. Na wa oo..See Money.

NAIJA POLICE BEGIN DEY FIGHT BOMBING #naijapolicefightbombing

  
Shey Naija police wan enta inside Sambisa forest ni? Well,dem Naija police people don start to dey teach people how dem go take identify dem Terrorist dem wey dey bomb. D police people too also dey teach people d number wey dem go call if any Bomb something wan shele o.                                                 
  This thing wey dem start yesterday for Abuja na something dem wan do for all Naija oo.Frank Mba wey be talk talk for Police na hin say dis oo. He say dem go dey share different books and things wey go help people avoid bomb and identify dem Boko Haram people.

OSOBA,AMOSUN-FIGHT DEY HOT #osobaamosunenteronetrouser

  
Different people get different something to say on the matter. As Ogun state be now,everywhere dey Hot for politics there. The Governor-Amosun And Osoba-Former Governor dey fight o.                    
   Baba Osoba say Amosun no gree settle the people wey support am to win for 2011 well. Dem say dem get executive for the party,Say Baba Osoba want make more people dey executive dey enjoy Amosun government o.                         
    Na this one cause gobe o. Amosun say hin no go gree. Osoba say hin must gree. Dem con enta same trouser o.It even get one time wey dem dey use gun pursue themselves o. As the tin be now,dem don divide the party into two. Osoba say make hin follower no collect any work from Amosun government o.           
   Osoba say dem no go settle the fight say dem go see gbegen. Dem Oga nla for APC don say dem go settle am oo.Make we dey watch oo..

AYO FAYOSE-I NO FALL O. #ayofayosenofall

 
Mr Idowu Adelusi who be talk talk person for Fayose talk for hin Oga. Fayose say hin no fall o.Fayose say d video na lie oo. Say hin no fall from d stage wey dem take do campaign o. Hin say na hin enemy do this video make it be like that.                                                         
  The Campaign wey dem do For Ifaki-Ekiti na this one take happen o. Fayose say d stage spoil but nobody fall o.Say na because people too many on top am o.       Fayose talk again say hin no fit follow Fayemi Kayode do debate, because Fayemi don bribe d people for ther
e. He say dem go don give Fayemi the question already. He say if dem don see beta people wey fit do am,Make dem con call am.

BUS KILL OLD MAMA #oldmamapai

  
Na for Ojodu-Berger for Lagos-Ibadan Expressway this one shele o.This mama wey be Cleaner for one company stand beside road yesterday(Monday)morning o around 6:30.Before you know,she don peme.How it take Happen?                  
   People wey dey there say some people wan cross road o.Na so one bus and one Van slow down make dem cross o.Before you know,dem hear gba for dem back.One truck hit dem for back o.Na so d bus lose control go kill Old mama wey stand jeje on her own o.                           
   Dem Police people say dem don catch the person wey drive the truck o.Dem say dem deal with am oo..Na mistake to stand for road again?

NAIJA COACH-KESHI DON BRING AM OOO #keshidondroplist

Wetin Stephen Keshi bring? Ehh..Na the name of people wey go show face for Naija team for Brazil oo.Na for midnight of Monday baba Keshi bring hin list oo..No be small sometin,abeg come check am out.                                                             
Goalkeepers: Vincent Enyeama, Austin Ejide,Chigozie Agbim
Defenders: Joseph Yobo, Elderson Echiejile, Juwon Oshaniwa, Godfrey Oboabona, Azubuike Egwuekwe,
Kenneth Omeruo, Efe Ambrose,Kunle Odunlami.
Midfielders: John Mikel Obi, Ogenyi Onazi, Ramon Azeez, Michael Uchebo, Reuben Gabriel
Forwards: Osaze Odemwingie, Ahmed Musa, Shola Ameobi, Emmanuel Emenike, Babatunde Michael,Victor Moses, Uche Nwofor.
O boi..Wetin una tink ooo?

DOCTORS DEY ON STRIKE #doctordeystrike

Doctors wey dey live for dem work place say dem dey go on three-days strike all over Naija.Dem association wey dem dey call National Association of Resident Doctors of Nigeria, say dem no go gree o.
Dem association say Oga Federal Government must to do wetin dem promise o.Dem dey talk too about the way dem dey collect their money say dem ghas to change am.Hospital like dem UCH(University College Hospital) for Ibadan say dem don follow dem doctors talk say make all of dem no go strike o.Say make people no go dey peme anyhow like chicken.

WE GO SEND DEM BACK GO SCHOOL-BORNO STATE GOVERNMENT #governmenthelpforborno

Na Borno state Governor talk this one o.This one happen when Chairman(Mr Baana Lawan) Of Chibok Local Government, carry 27 girls and 32 parents go Governor Office oo.The Governor wey be Alhaji Kashim Shettima say dem don spend reach 10billion naira to fight Boko Haram since 2011 o.Say Na only 200million Naira Federal Government.                                           
  He say he dey promise say all the girls wey dem don release wey come hin office,Borno State government go send dem go complete deir skul for other places for Naija oo.

BOKO HARAM KILL NINE PEOPLE FOR BORNO CHURCH #bokokllpeople

Boko haram chuk face for Borno for Sunday oo.These Boko Haram people wey reach dere for around 9:30 for morning carry gun and big big weapon come oo.Dem manage to kill like nine people for the church.                                 Ah,when people for the area see say dem don waste innocent people dem,Dem quickly call demselves together.The people for the area vex kill up to 37 Boko Haram people dem.Na wa o.Everybody for the area dey fear,Church sef no gree hold service again.Kai.. Chai, there is God ooo..(For patience voice)

FIRE FOR HONEYMILL FACTORY #fireforfactory

Fire burn Honeymill factory for Ikorodu o.Dis honeymill wey dey do flour dey for Ikorodu oo.As 9am reach for saturday morning,na so PHCN bring light oo..Dem first bring low current oo.Before ya know,dem bring high current ni oo.          
The people wey dey work for dere try kill d fire oo..As dem see say d tin pass dem power,dem call 'pana pana'-Fire fighter people oo..Dose ones quick come o as dem use 10,000litres kill d fire.                
The fire wey start from one room for the company,burn many furniture and spoil some file too.

BOKO HARAM KILL 60 PEOPLE FOR HOTEL #bokokillpeople

For Mubi for Adamawa,gbegen shele,everywhere scatter for Sunday, first day for June 2014.Dese Boko Haram people attack again oo.Dem go one hotel and shayo joint go bomb oo.                              
This place for Adamawa dey close to dem soldier barracks oo.Na around 6pm dis tin happen o.Kai,see as everywhere dey on fire.No be small tin oo.Up to like 60people peme for d mata o.

Sunday 1 June 2014

HAPPY NEW MONTH

Una ft Use this pics as your wallpaper or ontop your phone.
Make una send una Chicken down make we jollificate together

HAPPY NEW MONTH . #newmonth

Na we for PIdgintori dey wish una Happy New Month so...
Happy new month
No forget follow us for
Facebook : Pidgintori
Twitter : @pidgintori

FOTO FOR THE DAY- #fotoforday

Na the latest University for 9ja be this o... Wetin una think?