Tuesday 29 April 2014

Fire Dagbaru Shops For Ejigbo Market -- #fireforejigbomarket


Fire bin shele for Sunday wey dagbaru shops and goods wey reach millions of naira for Ejigbo market for Lagos, southwest for Naija. Millions of naira kept wey dey the shops for the market bin burn.
The gbege shele for 11 a.m. when workers for furniture company, Bella Akoussan Furniture, bin dey burn sawdust wey dem comot from their wood work.
When them set fire on top the sawdust, them be no fit control am as the fire they enter the other shops. (Na fire be this ooooo... Na gbege be this ooo)
One eye witnesses yarn say the fire bin cause havoc before dem fire service people show face.
One person wey her shop burn Patricia Okeke, yarn say she don warn person wey get the place and even don report give dem Police. Patrica,who dey distribute beer, yarn say she don loose close to N5 million, with her cash wey bin dey the shop.
 

Monday 28 April 2014

Foto for the day- #naijaeconomy

See wetin naija economy dey cause. Con call Uncle Shorty make in con ON your Gen for you. In na specialist

Adamawa don get diamond and coal for large quantity, dem Governor don yarn Nyako -- #Adamawadongetdiamond



Governor Murtala Nyako of Adamawa, don yarn for Sunday, say the state don get diamond for Large Quantity, say dem won begin dey exploit am.
Nyako talk am for Yola when in dey find questions from journalists on top resource control matter.
In talk say the state get coal and other natural resources, when some oyinbos for russia don con do survey when dem see say mineral resources dey the state. In talk say where coal dey, gas go dey.
He noted say the gas go turn fertiliser for farmers for the country, them go even export am.
In talk say time gas dey for exploration and exploitationn to make state wey no get oil fit prepare well to get something wey dem go dey get money from. In talk say 10 years don do for that one.

Shey una no go dey run go Adamawa like this?
 



 

See Mr Nigeria 2014 -- #mrnaija2014

Emmanuel Ikubese, don become ‘Mr Nigeria 2014″ for Saturday night when them talk am for Eko Hotel and Suites for Victoria Island, Lagos.
Ikubese, wey be 25-year old actor, bin win car,modelling contract of N1 million prize money and in get opportunity represent Nigeria for “Mr World” contest for Netherlands later this year.
Them first reduce from 10 before them con reach 5, na dem Silverbird group dey organize am every year.
Austine Igwilo and Michael Amilo bin become first and second-runner up positions.
Ikubese yarn say in go use in position be good role model and in won inspire millions of youths and encourage them run follow their dreams.
In talk say in go do in own campaign against HIV/AIDS .Ikubese bin study International Relations for United States International University for Nairobi for Kenya, wey come from Kwale for Delta State.

Namadi Sambo brother don pai for car accident -- #sambobrodonpai


Vice President of Naija, Namadi Sambo don loose in brother for car accident for Abuja.
Na Senior Special Assistant for Media and Publicity to Vice President Namadi Sambo, Malam Umar Sani, for Sunday announce say Capt. Yusuf Sabo Sambo don pai, the next small brother to Vice President.
Sani, talk say the motor accident shele for Bill Clinton Drive, Airport Road, Abuja.
Report talk say Vice presido brother bin dey work as pilot, who work for former Nigerian Airways and the Presidential Air Fleet, before in retire go private practice.
Report bin also talk say them born Capt. Sambo for1956, in con pai at the age of 58 years and in leave in wife, 3 daughters, 10 brothers and sisters.
Report talk say Them don bury am for Apo cemetery, becomes of them Islamic rites.Them bury for where them former military President Gen. Ibrahim Babangida, former Head of State, Gen. Abdulsalami Abubakar and other big big men wey don pai. President Goodluck Jonathan don go Aguda House residence of the Vice President for Presidential Villa, Abuja, to go console am.
 

Friday 25 April 2014

Dangote, Okonjo-Iweala don enter Time’s Top 100 people wey get mouth for the whole world -- #dangoteokonjogetmouth


Person wey rich pass for Africa, Aliko Dangote, and our Minister of Finance, Dr. Ngozi Okonjo-Iweala, don enter list of 100 people wey get mouth pass for the whole world na Time Magazine yarn am.
Person wey get Microsoft and and in second person, Bill and Melinda Gate Foundation, Mr. Bill Gate, write give Dangote as in Enter this list, in hail am for polio eradication and job wey in don dey create.Gate shock as in reply sharpaly, Buno, one lead singer for U2 and second person for One and (RED) been write Okonjo-Iweala’s tribute.
Dem classify Dangote for Titans category,wey boasts of eminent world people like them former United States Secretary of State, Hillary Clinton; Jeff Bezoz, Tony Fadell and Janet Yellen.
Pioneers category na Jason Collins, Natalie Massenet, Mary Jo White and Edward Snowden, among others.
Barbara Brown Taylor, Robin Wright, John Green and Kerry Washington were in the Artists category; while Jerry Brown, Okonjo-Iweala, John Kerry and Angela Merkel were listed in the Leaders category.
In the Icons category were Pope Francis, Alice Waters, Marina Abramovic, Cristiano Ronaldo and Carl Icahn, among others.
The Time 100 na annual list for 100 people wey get mouth pass for the world wey American news magazine gather .


 

Thursday 24 April 2014

Terry G give Hotel Manager Blow -- #terrygblowmanager


Ogbonge Singer and producer, Gabriel Amanyi, A.K.A Terry G, don follow person fight for iju.
The fight shele for Treasures Exclusive Garden, off Bola Tinubu Road, Iju, Lagos for 6p.m. for Wednesday.
Report tell us say Terry G and in boys con chill for the place, but before dem comot, some staff for where dem hangout get quanta with Terry G and in people.
Report tell us say as Terry G show the place, one of in boys jump for swimming pool pakata...
One of them hangout’s attendants been tell the boy make in comot (oga,comot the pool ooo), but in no comot. But when them force am out so, na so them Terry G people para for them. We even hear say Terry G just dey blow the Manager dey go. pa,po,gbish,gbam...(My face o, this punch too much ooooo) 
Another source con talk say Mr. George Obot, wey get the hotel yarn say, make the boy comot, but Terry G dey hala say.. (Wetin u think say u get sef)
The owner of the place talk say in pain as Terry G dagbaru in place. In talk say Terry G don fall in hand.
Terry G don fall plenty people before now when in get quanta with Side One for Benin City.

Chris Brown go dey jail till June cos in trial don dey delayed(#Chrisdeyjail)








Chris Brown go stay jail till June after in D.C assault trial bin dey delay for months. In lawyer bin apply for in bail yesterday but dem judge for L.A bin turn am down.

In trial bin suppose start yesterday, April 23rd but bin dey delay becos in bodyguard, Chris Hollosy, who dem don say in guilty before won talk say na him punch the face of the fan, but dem no gree hear am. Chris Brown's trial don dey hold until after Hollosy's appeal don end and in go shele in few months time.If dem see Chris say in guilty, in go face four years for prison.
Chris Brown bin dey pressed when dem talk am when dem no gree in bail. dem don send am go California for Con-Air for chains ma ke in gowait for in trial date.
 
eeyyyahhh   ....     Na wa ooo... This life sef, make God dey safe person na in remain
 

Foto: Dencia don buy 2014 Range Rover Evogue(#denciabuyrange)

She put the pics for her instagram page.See wetin she tweet

Wife don accuse Pastor husband for assault(#assultbypastorhusband)


Bessem Okafor,wife of the Pastor of Mountain of Liberation Miracles Ministires, Dr. Chris Okafor, don accuse her husband for beating her up for their house for Magodo, Lagos.
Bessem wey comot her house for 2012, yarn say,she been go see her pikin them wey dey leave with in husband.
The visit been don dey arranged by one lawyer for Office of them Public Defender, Lagos State Ministry of Justice, and her husband lawyer, Mr. Onyechukwu Ubani.
She yarn say, “I never see my pikin for nine months and our lawyers been agree make i con see them for house by 5pm after school. She yarn say she dey the compound till 10pm before her husband show. By 12am, the driver con carry the pinkin come house. She yarn say her pikin say make she stay with them till them come back from school after she bath dem finish.
After her children comot school,Chris been call Bessem for phone make she comot house . When Bessem con talk say she won stay till her pikin them come back from school wey Chris no gree, in con send one policeman to in house.
She yarn say, “The policeman tell me make i comot house and i don wash my undies by then since i no carry extra.“I tell the policeman say i go comot after my children return from school. Later, Chris con come come house con dey drag me"
She talk say some policeman come arrest her, but she no fit follow them go because her clothes don tear
The next day, she go complain for Isheri Police Division, she con dey hospitalised for Solid Rock Hospital,for Ojodu/Berger area.
Chris lawyer, Ubani yarn say, “Bessem dey enter house anytime, she no dey tell her husband where she dey go. She tear her clothes by herself.
We never hear from the husband himself wetin in won talk..
Wetin una think about this tori


Assult for Ejigbo:Lagos yarn say police report dey delay Judgement (#ejigboassult)


Lagos State Government for Wednesday yarn say them dey expect report from them police on top the two women wey dem do anyhow for Ejigbo.
Mr Ade-Ipaye, Attorney-General and Commissioner of Justice, yarn this one for the 2014 ministerial press briefing wey shele for Ikeja.
In yarn say the state Office of the Public Defender don conclude all arrangements to show them victims pepper.
Some kind men been put pepper for the women toto by some kind men for Ejigbo. One video been show the recording of the way dem do am, wey dey everywhere for December 2013.
 Oga Attorney-General yarn say the state government been dey commited to protection of right for in people.
In yarn say government, through the OPD, don carry some people and organisations.
Ipaye yarn say the government been able to get compensation for one Alexander Ossai, wey loss in pikin to assult wey shele to her by her Lebanese employer.
Oga Attorney-General yarn people make them report case of abuse of rights to them appropriate government agencies for help kiakia.

Wednesday 23 April 2014

Edo govt won create 200,000 jobs from oil palm(#edoilpalm)


Edo State Government yarn for Wednesday for Benin, them yarn say 200,000 jobs go dey created from oil palm production by 2015.
 The state Commissioner for Agriculture and Natural Resources,Mr Abdul Oroh, yarn News Agency of Nigeria say oil palm go create more job, wey go even add value to industrial growth
In yarn say, “For labour intensive crop, oil palm na major employer of labour; our aspiration is that by 2015, oil palm sector for don reach at least 200,000 youths.
“The state won use additional 100,000 hectares annually, to create jobs and create wealth.”
The commissioner yarn say,  “We go provide infrastructure to move farm product from village come city.
He in con yarn say the sector go give the state better money.

Wetin Nyanya blast cause: Military checkpoint don cause traffic(#checkpointforabuja)


After Nyanya bomb blast wey shele for Monday April 14th, wey pai pass 80 people, military checkpoints don dey some kind places for FCT.
Motorists and them workers say them checkpoints don cause big wahal for them as them fit reach work late and in fit cause make them querry them for place of work.
 
Channels TV, talk say residents for Abuja say them dey as them military men dey carry out their search. Them talk say this way wey dem dey carry out this serach fit even make them Boko Haram strike for the hold up. Them con dey beg make them Military men dey find better way to do their search.

Nollywood actor Chris Nkulor don pai after in kidney wahala(#ChrisNkulordonpai)


Nollywood actor Chris Nkulor don pai after in suffer kidney wahala. He pai yesterday for Obafemi Awolowo University Teaching hospital for Ile-Ife where them dey treat am.
U fit share wetin u miss about am

Ogbonge Singer Tiwa Savage don reach Dubai for her Wedding(#tiwafordubai)

Tiwa Savage just show face for Armani Hotel, Dubai for preparation for her white wedding to her hubby/manager Tunji “Tee Billz” Balogun wey go shele for this Coming Saturday 26th April 2014.
Them welcome her with bouquet of red roses as she she dey show face for there.

Ini Edo don share sexy bikini pic as she add 1 year today(#Inidonadd1)

The actress been share the pic on top her instagram page with one special message to mark her birthday today. She been write "In all... Am most grateful to de one God I serve Jesus Christ in whom am most pleased. He's kept me alive and my career soaring. I might nt get it right all de times but he never fails. He's been my light in times of darkness nd he's promises are yea and amen."





Make una start to wish her Happy birthday


Tuesday 22 April 2014

David Moyes we no want u again, Manchester United Yarn(#DavidMoyesCondeygo)

Manager David Moyes don comot Manchester United, the club yarn am for their Twitter account today.
“The club don thank am wella for in hard work and say in honesty.
The news come in today as them British media dey yarn, David Moyes just spend 10 months after Alex Ferguson as manager for the world-famous club.
This 50-year old Scot Man try no be small as them United fall to 7th place for Premier League and them comot them from both domestic cup competitions and the Champions League.
This player-coach Ryan Giggs and in former United team-mate Nicky Butt them talk say them go be caretaker for Saturday’s home game with Norwich City.

Hitachi won do fastest elevator for the world(#hitachielevator)


Japan Hitachi talk say dem go provide fastest elevator for the world, wey fit go for 72 kilometres (45 miles) per hour, for high building in China.
The lifts go cover 111-storey, 530-metre (1,740-foot)-tall Guangzhou CTF Financial Centre wey go open for southern Chinese city of Guangzhou in 2016, dem electronics and engineering firm talk so.
The elevator go dey travel with length of 440 metro shaft, from first reach 95th floor, all for only 43 seconds.
Hitachi go install 95 elevators for the tower, even them 2 superfast lifts, plus slower machines like them double-decker lifts, them talk am so.
The centre go be the tallest building in Guangzhou, in go get office, hotel and people go fit dey leave there.
The fastest elevator for the world dey use permanent magnet motor wey dem just discover dey achieves both thin profile and high output, them talk am for the statement .
It is also equipped with a braking system capable of withstanding the terrific heat that might be generated if a malfunction ever develops.
Chinab dey  accounts for about 60 per cent for global demand for elevators and na in be the centre of fierce competition wey dey among the world’s elevator makers, one Hitachi official talk so.
The world’s fastest elevator for now dey move with 60.6 kilometre per hour lift at Taipei 101, wey dey Taiwan’s main city, in talk so.

Monday 21 April 2014

52 people pai for Ogun auto crashes for 3 months(#52paiforOgun)

52 people don pai for 66 accidents wey don shele for Ogun from January to March 2014, na wetin Federal Road Safety Corps (FRSC) talk today for Abeokuta.
Sector Commander, Adegoke Adetunji,been tell News Agency of Nigeria (NAN) say 264 people get injury during the time wey dem review am.
In talk say the result indicate say the accident don reduce pass last year own, when 107 people pai and 674 people injure for 218 accidents.
Every month breakdown, in talk say the command record total of 158 casualties for 24 crashes wey shele for January 2014, wey 22 people pai and 90 people injure.
Adetunji talk say for February, 207 casualties for 20 crashes, wey 12 people pai and 89 injure.
“In March, we recorded 177 casualties in 22 crashes, where 18 persons lost their lives and 85 injured,” he said.
Adetunji talk say most of the crashe wey shele say na speed, dangerous driving and violation of not traffic rules, in con tell road users make them follow traffic rules and regulations for all times.

Fire Scatter Kaduna Airport control tower (#FireScatterKadunaAirport)

Fire been scatter control tower for Kaduna Airport.
Dem people wey dey there when in shele talk say the fire start by 3pm wey fire con dey the whole building.
Yakubu Dati,person wey dey yarn for Federal Airports Authority of Nigeria, FAAN,been no dey around to yarn more tori. Wetin cause the fire? We never really know....
The cause of the fire we no even know
U fit place your comment below, and no forget tell your friends about pidgintori.

CBN release Small Small Notes make we fit sell our Market- Traders dey Shout(#tradertoCBN)

Traders for Lagos don tell CBN say make them mint plenty more lower naira notes make them dey get change sell their market.
Them talk say in don dey affect their business.    Ayisat Bello, wey get stall for Ayobo market, small small naira note wey no dey available dey really affect her business.
“Na only N1000, N500 notes customers dey give me even if dem won buy shikini things like soap and biscuits.
“Getting ‘change’ na in be the wahala because in don really affect my business, “na so she talk.
Another person wey dey get shop for Iyana -Ipaja, Ada Nwachukwu, talk say she no fit sell at times because she no get change give customers.
“In dey pain me say i dey turn customers down because of this wahala.. Customers dey bring N1000 to con buy N100 goods, u con check your purse con see say change no dey, con see say na only big big notes dey.
“You fit even ask your other trader make them talk say na the same wahala dem dey face”, na so she talk.
Nwachukwu tell government CBN make them do something make small small notes fit dey available.
Tori different for Agege. Peculiar Adetu,talk say she dey always buy small small notes for Agege Motor Pack to solve her wahala.
She no won dey run up and down for change na so she do am so, in even dey affect bus conductors too. Them dey talk say 'Enter with you change o' wey fit make some Civil Servants for bus-stop for a long time

US write give Jonathan, Do something about Boko’Haram(#JonaDoSomething)

In pass 13 US organisations wey don write give Presido Jona, them talk say make in do something about them Boko people. After naija "Boko Haram" join body don become no 2 "deadly terrorist group for 2012".Wey Al Qaeda con be their only oga.

The WG wey dey Washington, United Nations and International Criminal Court wey dey Hague, Netherlands been follow oga Presido on top the Boko Haram and them other people wey won attack for Nothern part of Naija.

The organisation,dem for the letter wey dem write so for April 15, a day wey dem dagbaru Nyanya motor park wey dey Abuja,dem tell President Jona for the letter say Boko Haram don dey make dem they worry about people wey dey North and 15 other country wey don die for them hand.

WG talk say, “In don pass 5000 people wey don die so for Boko Haram hand even the members of the UN staff wey dey 2011 UN bombing. Them also talk say attack plenty pass for naija for 2012 pass the whole world all join together,wey dem even dey target the Houses of God pass.

“Dem also talk say Naija wey dey always accommodate countries wey dey fight before con become country wey dem go dey run from to go Cameroun, Chad and Niger. Dem talk say the tori gas change back. Them talk say dem go join naija to make am.


Suarez dey focused(#Suarezdeycalm)








Liverpool striker Luis Suarez talk say in no dey carried away with his chance to win Premier League.
Brendan Rodgers’ team dey 5 points for top of the table wey dey narrowly win Norwich 3-2 for Norwich City at Carrow Road for Sunday.
Raheem Sterling been score 2 times in con work out the another for Suarez, in talk say the gas maintain focus for their next game wey be 2nd place aginst Chelsea.
“We dey happy because we get 3 points,wey dey important to us,” in tell Sky Sports.
“We been work hard today. To play Norwich no be small thing and them dey fight make dem no dey relegation. For football person no fit talk wetin fit happen.In be like say we gas calm down and focus on how next game. In dey important.
“For beginning of the Sseason, we been plan dey top 4 and now in be like say in don happen.





 
 

 

Pastor Kumuyi fall yakata for Deeper Life Camp for Easter Retreat(#pastorkumiyiretreat)


Tori reach us say the Oga patapata for Deeper Life church, Pastor W.F Kumuyi fall yakata for Easter retreat wey shele on Saturday.
Them don carry am go hospital since then and in don dey dey better.Them no talk which hospital dem carry am go.
Dailypost con talk say, “Pastor Kumuyi no fit take early momo Faith Clinic for Saturday because of in health issue. In no fit continue with the retreat because of in condition, them con rush am go hospital. them dey treat am now."
“Them talk say make we pray for am,we don dey do so, but in no con minister a day before this shele, this don dey make the member dey fear fear"
Make we dey pray for am so

Friday 18 April 2014

TUNDE KELANI-I NO GO RELEASE MY FILM FOR NAIJA AGAIN O. (#kelanifilm)

Baba wey dey do film for Naija,Tunde Kelani say hin no go sell hin film for Naija market again o.Hin say it no reach one day wey hin bring out film,say dem pirate boiz don begin dey sell am.He say for time wey don tay say hin don dey manage to put hin film for Market.                                   
 The Name of d film na Maami,He say na people dey give am money to take do film.Na dis tin make baba Kelani say lai lai hin film no go dey Naija Market for sale again oo..Before dem wound am finish.

OGUN STATE POLICE GBAB ONE MAN WEY COMOT SMALL PIKIN HEAD(#pikinheadcomot)

Dem Ogun state Police Command arrest one man-Mamodu Ibrahim wey kill two-year old boy.                                        
Person wey dey talk for police-Muyiwa Adejobi Say dem Arrest Ibrahim on April 12 for 9:30 for night.                                  
The man by force Nak d boy mother before he kill d boy run comot for dere.Ibrahim say hin do d wicked sumtin oo..D Commissioner-Ikemefuna Okoye say dem go dey give wicked people wahala for d state oo..He say make d family accept hin sympathy for dem o.