Monday 28 July 2014

Another bomb don happen for Kano this morning -- #bombingforkano

Nigeria Police Force don announce another bomb blast wey happen this morning for NNPC mega station along Maiduguri road in Kano state.
More tori later


Dele Momodu don bet with Doyin Okupe finish -- #delemomdudonbet

Dele Momodu don bet with Doyin Okupe, wetin una think about the bet?
Na next year we go know. Make we dey watch

See wetin Dele Momodu Yarn -- #delemomoduyarn

See wetin Dele Momodu yarn

Wizkid go paint Newyork Red-- #wizkidpaintnewyorkred


Sunday 27 July 2014

Dem throw Bomb for Inside Catholic today, Pai Five for Kano -- #BombforCatholicChurch

Dem boko haram don go scatter Kano again. We hear say one explosive bin blow inside St. Charles Catholic Church for Sabon Gari area of Kano this afternoon by boko haram don pai 5, wunjure(injure) many.
Police believes say na one attacker throw the bomb into the church from across the street as the mass finish. No be the first time dem attack the church by dem boko people.

Boko Haram don carry Cameroon’s Deputy Prime Minister’s Wife

Boko haram people don carry the wife of the Deputy Prime Minister of Cameroun and one of her maids this afternoon from their home. We hear say Boko Haram people been get small fight with Cameroonian soldiers this afternoon and pai four of them, they enter the house of the deputy Prime Minister, Amadou Ali and carry in wife comot. The Prime Minister wey bin dey house when in happen try run comot town wey dey their side. Na Cameroun’s Information Minister wey be Issa Tchiroma yarn am.

Weightlifters,Yinka Ayenuwa & Ndidi Winifred don Win Silver Medals for Commonwealth Games -- #CommonwealthGames

After 16 year old Chika Amalaha don win Nigeria’s first gold for the 2014 Commonwealth Games for Glasgow, United Kingdom
For Day 3 wey be Saturday 26th July 2014, two Nigerian weightlifters wey be Ndidi Winifred and Yinka Ayenuwa don got silver medals for the ongoing commonwealth games.
Naija dey 11th position for the table,
Dem get 1 gold, 2 silver and 1 bronze, naija get 4 medals for the table in total.

Foto: Otedola’s do 3-In-1 Party For Dj Cuppy (foto) -- #otedolapikinbirthday

Ifeoluwa Otedola wey you sabi as Dj Cuppy  bin do 3-in-1 party yesterday, wey her parents bin host for her for the city of London. She do the party to celebrate her graduation from King’s College London, her birthday and her album launch. The party happen for 5-star Mandarin Knightsbridge, London. 
See more foto inside 

No call me Tuface again, call me Tubaba: 2baba -- #TufacetoTubaba

Ogbonge Artist, Tuface don change in stage name. Innocent Idibia wey you sabi as Tuface don spend 17years for music industry yarn for Thursday for in 6th album release party wey in call- The Ascension, in yarn say no call me Tuface again, dey call me Tubaba.

In yarn say :
”2face don dey this industry for 17 years, and in dey grow stronger. I dey hold send-forth party for 2face, and after this night event, na Tubaba una go dey call me”.

Saturday 26 July 2014

Wetin dey happen for here? -- #SaturdayQnA

My Ogbenge people, wetin una think say dey happen for here?

BREAKING NEWS:39 Worshipers Pai for Aba During Night Vigil -- #39paiforchurch



  People for Aba yarn say worshipers pai for church and even the pastor. Na like over 39 people pai for Encyclopedia institute of theology and research wey dey Eziukwu road for Milverton Aba. We never know wetin cause the death. We go update una soon.

Picture for the day

Why una think say girls dey use short words when dem dey chat or smiley.
Oya, read this and put comment.

Discussion for today: Tribal mark matter -- #tribalmarkmatter

Wetin una get yarn for tribal mark matter for Naija...
Oya share with us
U fit give your pikin tribal mark?
You get tribal mark?
Wetin una think, oya share with us, make the discussion begin.

Wedding for Today: Pastor Ashimolowo Pkini traditional wedding ceremony (foto) -- #ashimolowopikindeymarry

One of the sons of Senior Pastor of Kingsway International Christian Centre, (KICC) Matthew Ashimolowo dey do in traditional wedding now now as you dey read so. 
Tomi Ashimolowo dey marry in Sierra-Leonian girlfriend wey be Dorothy Jeneba Kamara for KICC Prayer City for Kent today.

See foto inside

Con follow Atiku talk for Twitter -- #LetsTalkJobs


Con follow atiku yarn for twitter about Job.
Sharparly go follow am yarn for twitter. #LetsTalkJobs

Naija don win 1st Gold for Glasglow commonwealth 2014 -- #NAIJAWINGOLD

Na Friday(26/7/2014) Chika Amalaha win the first gold for women 53kg weightlifting event. more tori...

Friday 25 July 2014

Kaduna bomber form like say in be woman (foto)

 Them don catch the person wey be suspect to the kaduna bombing wey shele for wednesday wey dem won kill Former Head of state, General Buhari. 

Boko Haram Terrorists fit don enter Lagos -- #Bokoharamforlagos

Members of dem civilian JTF for Maiduguri, for Borno state capital don arrest 5 members of Boko Haram wey enter Damboa wey con enter bus wey dey go Kano motor park (Tashan Kano). DailyPost yarn say the suspects dey go Lagos, after dem military yarn say dem won takeover Damboa town.
One member of dem JTF, Ahamadu Mamman yarn DailyPost say some members of Boko Haram sect wey dey run comot from Damboa town, say dem civilian JTF dey catch dem for motor parks wey dey within Maiduguri.     More tori dey inside...

Liberian man wey dey infected with Ebola Virus for Lagos don pai -- #tributetosawyer

Yesterday, Lagos State Ministry of Health yarn say one Liberian man get Ebola virus, say in dey Lagos . The man wey be Patrick Sawyer, (pictured above) don pai.

Dem reports yarn say Patrick pai yesterday night for First Consultant Medical Centre, Obalende, Lagos where in don dey receive treatment. we hear say in condition just dey get comma dey go.

Sawyer, who be official of Liberian Ministry of Finance, show Nigeria for Sunday July 20th for one conference.

PELLEGRINI SALUTE IHEANACHO -- #pellegrinisaluteihenacho

Pellegrini wey be coachi for Manchester City for England don salute Iheanacho oo..
Iheanacho na hin score plenty goal pass for the under 17 world cup wey Naija win last.
Iheanacho na hin score d last goal for dem Manchester City as dem beat Kansas City(4-1) for their pre-season matc.
Wetin una won yarn so?

Skales dey dash money for Fans.. VIDEO: SHAKE BODY by Skales |Win $10,000 For Fans Video Competition -- #skalesdeydashmoney

Skales don announce competition for one world press conference for Lagos, Nigeria, In yarn say them don sign am up for music label wey be Baseline Music – wey Howie T, and Dipo Abdul dey manage.
To sign-up for a chance to win the amazing sum, you go shoot video of yourself as you dey dance to in hit single ‘Shake Body’, and upload am to www.skalesmusic.com. The lucky winner of $10,000 US Dollars, them go choose the winner from popular polls.
 “Na popularity contest, but I thinksay make people begin go dey check the video for Shake Body before them record their own. We shoot the video so that people go fit thiefie thiefie some moves for the video ”, Howie T wey dey manage Baseline Music yarn am so.

Kano Bombing -- #kanobombing

In never reach 24 hours wey explosion shele for Kaduna State, Bombing con happen yesterday for New Road Luxury Park for Sabon Gari, Kano, on Thursday (7/25/2014) we hear say 5 people pai, and 12 people wunjure(injured) .
  Police yarn say na only one woman pai for the blast yesterday, say 8 wunjure(injured). The bomb shele for about 2:30pm when one luxury bus wey Ifeanyichukwu Industry and Commercial Services Limited just arrive the bus station from Port Harcourt.
The front view of the bus bin dey shattered, two other buses bin damage too by the explosion(as the bomb do "gbogaaaaa").


Read dey go.....

FOOTBALL TRANSFER -- #footballtransfer

Plenty tinz don shele for football o..Clubs just dey sell and buy.We go give una d name of player wey different clubs dey sell and buy for dis time oo..Oya Check am out:                                                     Mathieu Debuchy(Newcastle to Arsenal).         
Filipe Luis(Athletico Madrid to Chelsea).      
Brown Ideye(Dynamo Kiev to WestBrom).  
Alvaro Morata(Real Madrid to Juventus).      
Alexis Sanchez(Barcelona to Arsenal).      
Patrice Evra(Manchester United to Juventus). 

More players... dey inside     

Nigeria go soon break up - Bishop Oyedepo yarn -- #oyedepoyarn

Na wetin the G.O of Living Faith Church a.k.a Winners Chapel, Bishop David Oyedepo yarn say naija go soon break up.
"I hope say we dey find solution to this matter. Na me go last believe for the world say government never find people wey dey behind Boko Haram. If no be so then, we never get intelligence service for this country be that. Abi dem be maluu(cow) wey dey fear na why dem never fit expose them? 
Na Until we stop the source where dem supplies dey come from, we no fit stop them. 

See Wetin Asari Dokubo Yarn ontop Buhari Assassination Attempt -- #bokoattackbuhari

See wetin Asari Dokubo Tweet concerning General Muhammadu Buhari wey dem Boko Haram attack

Politicians dey buy human parts from me, (Foto dey inside)

Kwara state Police command on wednesday wey be July 23rd don gba two men wey dey sell human body part.
Them name na:
 Amos Kareem and Abubakar Ladan
Them arrest dem with human head, leg and hand for Tabira village, Okuta for Baruten LGA of the state, na wetin  'Vanguard' newspaper yarn.

When dem interview them, one of the suspect wey be Abubakar Ladan yarn say Amos Kareem promise say in go give am motorcycle if in fit find am human head, hand and leg. In talk say na because of the motorcycle wey in won get na in make him go into cemetery where in go cut off dead body heads, hands and legs (picture dey up).

Sunday 20 July 2014

Dele momodu tweet today -- #tweetfortoday

Wetin una think say happen wey dele Momodu take para like this?

Boko Haram don Pai RCCG Pastor For Borno -- #bokodonpaipastor

Boko people don pai one pastor of Redeemed Christian Church of God (RCCG) for Borno state.
Dem pai the pastor wey be Taiwo Dokun for Dille village for Askira-Uba local government area of the state for Monday.
Some members for RCCG yarn give jounalist for maiduguri say, dem no know where the pastor wife dey now with in 3 pikin.
“Dem Boko people fit don carry the family go as dem don see them since Boko people don comot, dem fit don carry dem go as dem never call anyone since then, because dem carry some villagers too go.
“We no fit find their body for inside people wey dem pai” one church members yarn the journalists.
“The pastor bin dey in house for 6am when them boko people bin enter the village, dem bin surround in house, as in won run comot, na in dem kill am,” Jacob Mamza yarn Jounalist as in take happen. na 45 people dem pai for this matter so.

Saturday 19 July 2014

See as how this Family Miss that Malasyia Plane-Crash wey Crash -- #luckyfamily

Barry and Izzy Sim  bin dey plan travel to Kuala Lumpur with them baby for Flight MH17 but them staff for Amsterdam's Schiphol airport tell them say the plane don full.

  Them con give the family KLM flight wey dey go next, that one na hours before the MH17 plane fall yakata for ground.

Mr barry yarn say “As i hear say the plane don crash. In just be like say i won sick… My heart dey beat pass Speakers sef.’.

In wife con yarn say; ‘ In be like say something dey guide us oo. Like say the thing dey talk say“make una no enter that plane ooo”.’ The couple con cancel their flight with KLM as the woman no gree make them follow the plane. 

U.S intelligence don yarn say na Pro-Russian, say dem think say na Ukraine military plane. Them don talk say Russian weapon dem use.

Miss Akwa Ibom don win MBGN14 - Iheoma Nnadi (photos) -- #MBGN

Miss Akwa Ibom don win MBGN 14 wey shele yesterday for Bayelsa. Iheoma Nnadi na 19 years old. She con dey model too.
Plenty foto dey inside

Thursday 17 July 2014

Dem don shoot one Malaysian passenger plane for Ukraine, 295 people don pai

One Malaysian Airline flight wey carry full body from Amsterdam to Kuala Lumpur don fall yakata for eastern Ukraine. Them be 280 passengers and 15 crew members for board.

Them Ukrainian Interior Minister for yonder don yarn say everybody for board don pai and say dem Russian anti-aircraft been shoot the plane with dem missile for 32,000 feet and for speed wey reach (500mph).


The plane wey be Boeing 777, being fall yakata near the city of Donetsk, wey be border between Russia and Ukraine where one Ukraine transport plane been collect gun shot for Monday July 13th and one military jet been collect shot last week from the Russian side for the border.

Interior Minister been yarn say pro-Russian separatists bin don dey hunt down them planes for weeks. Na 6 Ukrainian military jets dem don shoot down for the last few months by them Russians.
Military Quanta(Battle) don dey between Ukraine and Russia for a while now.

But shey na why this Gbege happen?

Jude don go Carry in own Baby - Jude and Ifeoma Okoye (foto)

In never too tey wey Paul Okoye carry Anita Enter Okoye family.
 Now na Jude dey do in own as in carry Ifeoma enter dem family .  More foto dey inside



See Foto for Where wizkid dey do in Birthday Yesterday nite -- #wizzyparty