Friday 22 August 2014

I go insure una:Oga Globacom dey yarn NURTW members say na N1m for each person-- #gloforaction

 Globacom don insure(guide dem lives, say if dem pai with money) live of National Union of Road Transport Workers (NURTW) with N1,000,000 each.
Steve Stretch, wey be Head of Glo Gateway, yarn say Globacom don partner with Security Verified Identity Card (SVID),  insurance scheme institute wey Globacom get, dem con dey partner with the NURTW, United Bank for Africa and Skye Bank.
In yarn say, if  person pai, say in next of kin go collect N1 million naira.
Say in go give person wey anything do in body wey in no go fit work again N850,000 and the person no go work again.
In talk say before dem fit enjoy am so, dem must to dey use Glo and dey buy recharge card of N1000 every month

No comments:

Post a Comment