Thursday 17 April 2014

Fulani Herdsmen(fulani people wey dey carry cow waka) Don Dagbaru Taraba state(#fulanifortaraba)

Dem Channels TV don yarn say some Fulani people dey attack people for Wukari Village wey dey Taraba .Dem people wey dey there when this thing shele don talk say nearly 15 people don die, but  olopa talk say na only 7 people don kpai. Dem reporters con yarn say na plenty houses don go down.
Some reporters con yarn say them see the wife of the governor for there Dr. Mrs. Hauwa Danbaba Suntai, but them don comot her from the place where the gbege shele.
Them Police Public Relations officer, ASP Joseph Kwaji don yarn say na the youths for the town dey dagbaru everywhere after them don yarn say na the m Fulani for another village for there.
 

No comments:

Post a Comment