Thursday 24 April 2014

Terry G give Hotel Manager Blow -- #terrygblowmanager


Ogbonge Singer and producer, Gabriel Amanyi, A.K.A Terry G, don follow person fight for iju.
The fight shele for Treasures Exclusive Garden, off Bola Tinubu Road, Iju, Lagos for 6p.m. for Wednesday.
Report tell us say Terry G and in boys con chill for the place, but before dem comot, some staff for where dem hangout get quanta with Terry G and in people.
Report tell us say as Terry G show the place, one of in boys jump for swimming pool pakata...
One of them hangout’s attendants been tell the boy make in comot (oga,comot the pool ooo), but in no comot. But when them force am out so, na so them Terry G people para for them. We even hear say Terry G just dey blow the Manager dey go. pa,po,gbish,gbam...(My face o, this punch too much ooooo) 
Another source con talk say Mr. George Obot, wey get the hotel yarn say, make the boy comot, but Terry G dey hala say.. (Wetin u think say u get sef)
The owner of the place talk say in pain as Terry G dagbaru in place. In talk say Terry G don fall in hand.
Terry G don fall plenty people before now when in get quanta with Side One for Benin City.

No comments:

Post a Comment