Thursday 17 April 2014

One naija man don enter gbege for India, in put heroine for woman shoe(#naijamancarryheroin)


One naija man, Ozioma Kenneth Odeomenan don enter gbege as dem catch am for new delhi wey dey india, dem catch with 330g of heroin wey reach $120,000 for woman shoe, wey in dey carry go America.

Dem India Police con yarn say na some unknown people yarn them say one naija man dey carry heroin come Janakpuri metro station. Some kind police officers con lay trap wey them con use catch Ozioma, them catch am with 330 grams of heroin wey in use sense put am for woman shoe. Ozioma con later confess say in dey carry am go to Mahipalpur wey go con finally reach US.

Dem India Newspaper(India Times) con yarn say Ozioma don school for South Africa before in con relocate go India in 2009, in con begin dey export shoe come naija., the business no con pay am before in con begin dey carry hard drug wey another Nigerian,ike, con introduce the business to am

No comments:

Post a Comment