Monday 2 May 2016

Police don catch 19 year old barber, kill am for Lagos


Vanguard yarn say Police don wonjure 19 year old boy wey in name na Gafar Ayoola, them don con kill am for Denton Police Station, Lagos State.

Police for Denton Divisional Police station, Oyingbo gba Gafar Ayoola as in dey go work for friday wey be barber for Okoafo, Badagry Area.

As the tori reach in mama and papa for house, them sharply go police station to know why them gba their pikin. The policemen wey dey duty say person wey dey bear that name no dey their cell.

In papa wey be Sulaiman Ayoola con go police station the day wey follow, na in one of them police yarn say them don rush carry in pikin go Dunik Hospital for Kano Street by Bola for Ebute Metta,where in con pai for there. 

No comments:

Post a Comment