Flow Rock, Sam Kings and them Bells University Choir(Brix City) bin perform Yesterday ,9th May 2014 for Bells University of Technology wey dey Ota. Them dey call the school Bellstech for Short. Flo Baba bin Scatter the Stage as in Climb the Stage. No be small thing so...
Them School Choir wey dem dey call Brixcity Choir bin also Perform, Sam King bin show too and them Other Guest artist.
Saturday, 10 May 2014
Friday, 9 May 2014
US ARMY don show for naija #usarmydonshow
Information wey we hear from cnn.com for early momo for 1:56AM yarn say 7 US army don show, 11 go show for morning. And like 50-60 go soon show
http://edition.cnn.com/2014/05/09/world/africa/nigeria-abducted-girls/index.html?hpt=hp_t1"> Watch the video for English
U go fear the way dem dey land.... Una get the mind join US army?
http://edition.cnn.com/2014/05/09/world/africa/nigeria-abducted-girls/index.html?hpt=hp_t1"> Watch the video for English
U go fear the way dem dey land.... Una get the mind join US army?
Wednesday, 7 May 2014
FRESH TORI !!! Boko Haram don pai 300 people , kidnap 11 more girls -- #BringBackOurGirls #bokoharamagain #whichwaynigeria
Members of them terrorist Islamic sect, Boko Haram, on Monday night(YESTERNITE) pai 300 people for Gamboru Ngala, Borno State. Gamboru Ngala na border town with Cameroon.
Them abduct 11 more girls for Warabe and Wala communities for Chibok Local Government Area of Borno State for Monday.
We hear say them con kill people for market. Gamboru na 200 kilometres from Maiduguri, the state capital city
Senator Ahmed Zannah, who dey represent the area for Senate, talk say the killing na true. In yarn say them spend reach 12 hours for there
Which way nigeria???
Them abduct 11 more girls for Warabe and Wala communities for Chibok Local Government Area of Borno State for Monday.
We hear say them con kill people for market. Gamboru na 200 kilometres from Maiduguri, the state capital city
Senator Ahmed Zannah, who dey represent the area for Senate, talk say the killing na true. In yarn say them spend reach 12 hours for there
Which way nigeria???
US i don tire, con help us - GEJ #usconhelpus #bringbackourgirls
For the foto:
Jonathan: Abeg con help us for Naija, me don tire ooo. Wetin dey happen?
Obama: I go send my boys, just calm down
Jonathan:I trust u say u go do something. Obama my own padi himself. U sure dieeeeeeee.
Person wey dey yarn for Presido, Reuben Abati for in website website yarn say Preido. Jona don accept make dem US con help naija find them girls wey dem boko people con carry like 3 weeks ago
Them yarn say na United States Secretary of State, Mr. John Kerry for telephone conversation wey shele for 15.30 Hours yesterday. Them con tell Presido Jona say make in calm down, say dem go find dem girls for naija here so
Them don catch dem Thiefiethiefie #demole
For early momo today, them con snatch the VINE INTERNATIONAL ACADEMY school bus, the school dey abuja. Wey dem parents con dey dey fear con dey carry them pikin so. Now them Olopa don catch the people wey con snatch am
The Special Assistant to the Minister of Federal Capital Territory wey be Nosike Ogbuenyi, yarn for statement say,the moto get registration number wey be XG 246 GWA, them catch this 2 men for Lafia wey dey Nassarawa.Them catch dem 2 inside.
Wetin una get to yarn about this?
Tuesday, 6 May 2014
Evil wey i no fit think for them Girls wey them carry go(BokoHaram) – Angelina Jolie #angenilajoliedonyarn #bringbackourgirls
US actress Angelina Jolie for Tuesday yarn say “unthinkable cruelty and evil”(that one mean say them boko people wicked die) for Pigdin. Say as them boko people kidnap them 200 schoolgirls so.
She yarn am for Paris for them themes so for yonder for their latest film wey be “Maleficent” for Disney.
“Evil dey this world,you watch news and you see people dey suffer and so many wahala. She talk am for news conference
276 students don move as them boko people carrry them so for Borno State, some be run comot, but them police yarn say 220 girls still dey with them Boko Haram
Yesterday for one youtube Video, Abubakar Shekau, the head of them Islamist wey don pai thousands for 5 years now con yarn say in won sell them girls.
Wetin Una think?
Tuesday, 29 April 2014
Fire Dagbaru Shops For Ejigbo Market -- #fireforejigbomarket
Fire bin shele for Sunday wey dagbaru shops and goods wey reach millions of naira for Ejigbo market for Lagos, southwest for Naija. Millions of naira kept wey dey the shops for the market bin burn.
The gbege shele for 11 a.m. when workers for furniture company, Bella Akoussan Furniture, bin dey burn sawdust wey dem comot from their wood work.
When them set fire on top the sawdust, them be no fit control am as the fire they enter the other shops. (Na fire be this ooooo... Na gbege be this ooo)
When them set fire on top the sawdust, them be no fit control am as the fire they enter the other shops. (Na fire be this ooooo... Na gbege be this ooo)
One eye witnesses yarn say the fire bin cause havoc before dem fire service people show face.
One person wey her shop burn Patricia Okeke, yarn say she don warn person wey get the place and even don report give dem Police. Patrica,who dey distribute beer, yarn say she don loose close to N5 million, with her cash wey bin dey the shop.
Monday, 28 April 2014
Foto for the day- #naijaeconomy
See wetin naija economy dey cause. Con call Uncle Shorty make in con ON your Gen for you. In na specialist
Adamawa don get diamond and coal for large quantity, dem Governor don yarn Nyako -- #Adamawadongetdiamond
Governor Murtala Nyako of Adamawa, don yarn for Sunday, say the state don get diamond for Large Quantity, say dem won begin dey exploit am.
Nyako talk am for Yola when in dey find questions from journalists on top resource control matter.
In talk say the state get coal and other natural resources, when some oyinbos for russia don con do survey when dem see say mineral resources dey the state. In talk say where coal dey, gas go dey.
He noted say the gas go turn fertiliser for farmers for the country, them go even export am.
In talk say time gas dey for exploration and exploitationn to make state wey no get oil fit prepare well to get something wey dem go dey get money from. In talk say 10 years don do for that one.
Shey una no go dey run go Adamawa like this?
Shey una no go dey run go Adamawa like this?
See Mr Nigeria 2014 -- #mrnaija2014
Emmanuel Ikubese, don become ‘Mr Nigeria 2014″ for Saturday night when them talk am for Eko Hotel and Suites for Victoria Island, Lagos.
Ikubese, wey be 25-year old actor, bin win car,modelling contract of N1 million prize money and in get opportunity represent Nigeria for “Mr World” contest for Netherlands later this year.
Them first reduce from 10 before them con reach 5, na dem Silverbird group dey organize am every year.
Austine Igwilo and Michael Amilo bin become first and second-runner up positions.
Ikubese yarn say in go use in position be good role model and in won inspire millions of youths and encourage them run follow their dreams.
In talk say in go do in own campaign against HIV/AIDS .Ikubese bin study International Relations for United States International University for Nairobi for Kenya, wey come from Kwale for Delta State.
Namadi Sambo brother don pai for car accident -- #sambobrodonpai
Vice President of Naija, Namadi Sambo don loose in brother for car accident for Abuja.
Na Senior Special Assistant for Media and Publicity to Vice President Namadi Sambo, Malam Umar Sani, for Sunday announce say Capt. Yusuf Sabo Sambo don pai, the next small brother to Vice President.
Sani, talk say the motor accident shele for Bill Clinton Drive, Airport Road, Abuja.
Report talk say Vice presido brother bin dey work as pilot, who work for former Nigerian Airways and the Presidential Air Fleet, before in retire go private practice.
Report bin also talk say them born Capt. Sambo for1956, in con pai at the age of 58 years and in leave in wife, 3 daughters, 10 brothers and sisters.
Report talk say Them don bury am for Apo cemetery, becomes of them Islamic rites.Them bury for where them former military President Gen. Ibrahim Babangida, former Head of State, Gen. Abdulsalami Abubakar and other big big men wey don pai. President Goodluck Jonathan don go Aguda House residence of the Vice President for Presidential Villa, Abuja, to go console am.
Friday, 25 April 2014
Dangote, Okonjo-Iweala don enter Time’s Top 100 people wey get mouth for the whole world -- #dangoteokonjogetmouth
Person wey rich pass for Africa, Aliko Dangote, and our Minister of Finance, Dr. Ngozi Okonjo-Iweala, don enter list of 100 people wey get mouth pass for the whole world na Time Magazine yarn am.
Person wey get Microsoft and and in second person, Bill and Melinda Gate Foundation, Mr. Bill Gate, write give Dangote as in Enter this list, in hail am for polio eradication and job wey in don dey create.Gate shock as in reply sharpaly, Buno, one lead singer for U2 and second person for One and (RED) been write Okonjo-Iweala’s tribute.
Dem classify Dangote for Titans category,wey boasts of eminent world people like them former United States Secretary of State, Hillary Clinton; Jeff Bezoz, Tony Fadell and Janet Yellen.
Pioneers category na Jason Collins, Natalie Massenet, Mary Jo White and Edward Snowden, among others.
Barbara Brown Taylor, Robin Wright, John Green and Kerry Washington were in the Artists category; while Jerry Brown, Okonjo-Iweala, John Kerry and Angela Merkel were listed in the Leaders category.
In the Icons category were Pope Francis, Alice Waters, Marina Abramovic, Cristiano Ronaldo and Carl Icahn, among others.
The Time 100 na annual list for 100 people wey get mouth pass for the world wey American news magazine gather .
Thursday, 24 April 2014
Terry G give Hotel Manager Blow -- #terrygblowmanager
Ogbonge Singer and producer, Gabriel Amanyi, A.K.A Terry G, don follow person fight for iju.
The fight shele for Treasures Exclusive Garden, off Bola Tinubu Road, Iju, Lagos for 6p.m. for Wednesday.
Report tell us say Terry G and in boys con chill for the place, but before dem comot, some staff for where dem hangout get quanta with Terry G and in people.
Report tell us say as Terry G show the place, one of in boys jump for swimming pool pakata...
One of them hangout’s attendants been tell the boy make in comot (oga,comot the pool ooo), but in no comot. But when them force am out so, na so them Terry G people para for them. We even hear say Terry G just dey blow the Manager dey go. pa,po,gbish,gbam...(My face o, this punch too much ooooo)
Another source con talk say Mr. George Obot, wey get the hotel yarn say, make the boy comot, but Terry G dey hala say.. (Wetin u think say u get sef)
The owner of the place talk say in pain as Terry G dagbaru in place. In talk say Terry G don fall in hand.
Terry G don fall plenty people before now when in get quanta with Side One for Benin City.
Chris Brown go dey jail till June cos in trial don dey delayed(#Chrisdeyjail)
Chris Brown go stay jail till June after in D.C assault trial bin dey delay for months. In lawyer bin apply for in bail yesterday but dem judge for L.A bin turn am down.
In trial bin suppose start yesterday, April 23rd but bin dey delay becos in bodyguard, Chris Hollosy, who dem don say in guilty before won talk say na him punch the face of the fan, but dem no gree hear am. Chris Brown's trial don dey hold until after Hollosy's appeal don end and in go shele in few months time.If dem see Chris say in guilty, in go face four years for prison.
Chris Brown bin dey pressed when dem talk am when dem no gree in bail. dem don send am go California for Con-Air for chains ma ke in gowait for in trial date.
eeyyyahhh .... Na wa ooo... This life sef, make God dey safe person na in remain
Subscribe to:
Posts (Atom)














