Monday 14 July 2014

Rihanna cause kasala as she touch World Cup (Foto) #rihannacarrycup

Rihanna cause kasala yesterday after she snap foto where she dey hold 2014 World Cup trophy. After final match for yesterday when Germany win World Cup. Rihanna bin post foto for instagram where she dey celebrate with the team.



    Wahala wey dey now be say FIFA rule yarn say na only winner of the World Cup and them Head of state na in get permission to hold the world cup. Even Badgal RiRi no send as in hold am so
Rihanna sef no con send as her fans dey para say why she go carry the Cup.
Wetin una think my people?

No comments:

Post a Comment