Friday 25 July 2014

Politicians dey buy human parts from me, (Foto dey inside)

Kwara state Police command on wednesday wey be July 23rd don gba two men wey dey sell human body part.
Them name na:
 Amos Kareem and Abubakar Ladan
Them arrest dem with human head, leg and hand for Tabira village, Okuta for Baruten LGA of the state, na wetin  'Vanguard' newspaper yarn.

When dem interview them, one of the suspect wey be Abubakar Ladan yarn say Amos Kareem promise say in go give am motorcycle if in fit find am human head, hand and leg. In talk say na because of the motorcycle wey in won get na in make him go into cemetery where in go cut off dead body heads, hands and legs (picture dey up).


When dem con ask wetin in won do with human body, Amos Kareem yarn say in dey sell am to politicians. In no talk who the politicians be.

The police bin also catch one man wey dey accommodate(put them for in house) for Tabira village,in talk say in nio know the business wey kareem and Ladan dem do.
 My country people, wetin una get yarn so?

No comments:

Post a Comment