Tuesday 15 July 2014

Them don comot Adamawa state Governor, Nyako for Chair, in deputy con resigns too -- #adamawagovernordoncomotpost

Them people for Adamawa State House of Assembly this afternoon wey be July 15th don comot their Governor (Murtala Nyako) for Chair.
Murtala Nyako, wey dem yarn say after plenty investigate wey 7 people chuk eye inside, say in get wahala with some kind money so. Read dey go

 The report wey the State Assembly Speaker, Umaru Fintiri yarn for floor of the House, yarn say the Governor dey Guilty of the 16 wahala wey dem talk say in do so. 18 people for inside 24 members wey dey the State Assembly sign say make them Comot am from governor Position.

The House con put the Speaker wey be Umaru Fintiri, as Governor wey go dey there for now.
 We con hear say, the state Deputy Governor who them chuck eye for in matter on top same matter don comot the post as Deputy Governor wey in write Give the house. Before them con put leg on top am so.
My people wetin una get yarn for this matter?

No comments:

Post a Comment