Police yarn say na only one woman pai for the blast yesterday, say 8 wunjure(injured). The bomb shele for about 2:30pm when one luxury bus wey Ifeanyichukwu Industry and Commercial Services Limited just arrive the bus station from Port Harcourt.
The front view of the bus bin dey shattered, two other buses bin damage too by the explosion(as the bomb do "gbogaaaaa").
Read dey go.....
Person wey dey there (eyewitness) for the motor park, who no yarn in name, in tell "thenationonline" correspondent say, “one luxury bus just dey come from Port Harcourt, as the bus bin won park, passengers dey drop from the bus, i just hear(gbogaaaaa) as everybody begin dey run up and down.
“People begin dey run here and there, we see 5 dead body for ground, one woman don fly go another side. I no know maybe she be passenger or not.
“The luxury bus bin dey offload before the bomb explode, wey dem fit don plant am under the front seat"
One Umar Isah, wey dey the motor-park yarn say in see truck-pusher with one fridge inside truck, say in dey push am towards the vehicle, “and before we know am, we hear one alarming sound, sound wey scatter the whole motor park. The truck pusher injure no be small, na wetin in yarn.
Wetin una think, my people?
No comments:
Post a Comment