Friday 25 July 2014

Nigeria go soon break up - Bishop Oyedepo yarn -- #oyedepoyarn

Na wetin the G.O of Living Faith Church a.k.a Winners Chapel, Bishop David Oyedepo yarn say naija go soon break up.
"I hope say we dey find solution to this matter. Na me go last believe for the world say government never find people wey dey behind Boko Haram. If no be so then, we never get intelligence service for this country be that. Abi dem be maluu(cow) wey dey fear na why dem never fit expose them? 
Na Until we stop the source where dem supplies dey come from, we no fit stop them. 

 But the danger wey dey there be say, and I must yarn am, naija go soon break up. Na the truth be that. In dey unfortunate.Naija as a nation too get oplo(intelligent) for them to yarn say dem no know who dey behind dem boko people. So, i believe say na the hands of the authorities in dey now to decide whether they won confront the matter or to dey watch until naija break up...... Wetin Church won do na to pray. No be the church dey in power, in no get political power. If them invite us, we go advice, when dem require or dem call upon. You no fit call person, con yarn say i fit advice you?" - Bishop David Oyedepo

No comments:

Post a Comment