Tuesday 15 July 2014

Boko Haram don Pai 38 people for Borno -- #bokoasusual

38 people don pai after Boko people don raid one village wey dey northeast Nigeria yesterday.
The attack wey na for the Christian farming village of Dille for Askira Uba district, wey dey 200 kilometres (125 miles) from regional capital Maiduguri shele for Sunday night to Monday, them burn burn the whole village and even 3 church for there.. Na wetin the villagers yarn ooo...
Me no dey there sha


Them yarn say plenty gunmen show with them plenty plenty motor and them okada (motorcycle) bin show the village from around Sambisa forest where them Boko people dey fire anyhow, them con even  dey throw grenades and explosives for different house.
Them Villagers bin dey run inside bush, as them just raid for Buttuku village wey never too tey for them neighbouring Adamawa state, One Villager yarn so.
“The Villager yarn say like 38 people pai for Boko Haram attacks and even private military jet bin dey shoot as them villagers dey run comot the village.

Them Boko People don pai pass 2,000 people this year alone.
Wetin una won yarn so?

No comments:

Post a Comment