Friday 25 July 2014

Boko Haram Terrorists fit don enter Lagos -- #Bokoharamforlagos

Members of dem civilian JTF for Maiduguri, for Borno state capital don arrest 5 members of Boko Haram wey enter Damboa wey con enter bus wey dey go Kano motor park (Tashan Kano). DailyPost yarn say the suspects dey go Lagos, after dem military yarn say dem won takeover Damboa town.
One member of dem JTF, Ahamadu Mamman yarn DailyPost say some members of Boko Haram sect wey dey run comot from Damboa town, say dem civilian JTF dey catch dem for motor parks wey dey within Maiduguri.     More tori dey inside...


“We bin arrest 5 yesterday for Tashan Kano. In be like say 4 people pai and one of them wey dey alive, dey with dem soldiers. We don put our boys for Tashan Journey and for all local spots where vehicles dey pick passengers, even along roads and in don dey successful,” Mamman yarn.
In yarn say, since Boko Haram  don attack Damboa and dagbaru(scatter) the people, in dey obvious say, the war no be small thing, and dem no want make dem catch dem so, don dey run comot the area. In yarn say, most of dem wey dem arrest for Maiduguri and around there don dey run go south west. “Almost all of them wey we ask where dem dey go yarn say na Lagos dem dey go when dem ask where dem dey go"

 Lagosians make una dey watch your neighbours well o.. 
For inside bus, for bus-stop, for inside church, for mosque, for school, for work place, for market place.For where CROWD dey
BEWARE!!!

No comments:

Post a Comment