Wednesday 16 July 2014

Security person don arrest fake Boko Haram Person -- #fakeBokoharam

Defence Headquarters don polongo (announce) for arrest of one man wey dey make people mind dey run pass normal, them yarn say in dey send Text message give people say Boko Haram go Come meet them. 

The suspect wey be Ugwu Lawrence (in picture dey up) wey dem Security Catch after in don send the message finish, say( Boko people go attack some Hotels for Abuja for in message) . In con later confess say in do like that because one of them Oga for the Hotel no won give am job for in Hotel.     
In talk say in won make the Oga of the Hotel fear, say na why in do like that. In con dey beg say in no be terrorist. Police still dey do their investigate on top the matter. 

No comments:

Post a Comment