Kai..Dr Godwin Iwatt don pai oo.From d tori wey we hear,Na Dem cult boiz send am go meet Baba God o.Dis Dr Godwin na lecturer for University Of Calabar.Hin dey lecture Microbiology.
Una no go believe say na inside hin office dem kill am oo.Eh..Dem don send letter to am two times to warn am o.As hin no con hear,Na so dem carry gun go meet am oo..As dem shoot am,dem just run comot.D lecturer peme after nine days o.
Everybody for d skul dey fear now as police sef neva arrest anybody o.No lecturer wan gree to come class o.Kai..Chineke oo..Abeg helep o..
Thursday, 22 May 2014
NA WITCH? #nawitch
Na God save am,dem for kill am oo..Who? Well,na one woman wey dem see for Ojo road,Ajegunle oo. People say na witch o, say she dey fly for inside sky oo..
Some say dem see three bird for inside sky o,Say na so one land for road and turn to d woman. D woman don reach like 80 years o.Dem wan begin dey beat d woman oo until Baale for area call police o. D Baale say hin no believe say na witch o.Say some old people Brain don turn to small pinkin bcos of dem age.
Even as dem carry her reach police station,plenty people still reach dere say dem wan beat her oo..Fear sef catch police when dem see plenty people.kia kia dem call other police station wey close.Na tear gas wey dey pepper eye dem take send d people comot o..Kai...U tink say Na witch true true?

NO SCHOOL TODAY O-NUT #noschooltodayo
Omo,Nigerian Union Of Teachers(NUT) say no school for Naija today o.Dem say dem wan use today protest all over Naija.Dem say d Chibok girls mata don dey worry dem too much. Say dem no fit to keep quiet on top the Matter o.
Dem President,Michael Olukoya talk say dem Bokoharam don kill 173 teachers o.170 peme inside Borno and three inside Yobe. Hin con talk again say make Government dem dey protect student and dem teacher oo say make dis kin bad tin no shele again o.He con talk again say make dem give d family of d teachers wey don peme money o. God Help Naija o

BOMB FOR JOS #bombforjos
Dem Boko Haram bomb again for tuesday for Jos. Dem kill notin less dan 150people oo.For 3pm tuesday,One guy do like say hin tyre flat as hin cause hold up.People no know say na Boko Haram o.As Hold up dey,him just press one small button for d bomb,Na so him die with everybody wey dey d place o.
As people rush go help people wey wound for dere,Anoda bomb do'gbogbom' after 20minutes o..Ehh..See Confusion everywhere..
People dey run left,right,front,centre and back.Car wey wan do U-turn just dey burn anyhow cos of d fire wey comot from Bomb.Dem police and dem pana pana(fire fighter) reach dere shaa as dead body just full everywhere. Presido Jonathan don talk shaa say hin no go gree for Boko-Haram make dem spoil Naija.Hin say dem wicked say him sef go show dem wickedness and Hin go kill all of dem soon.

TINUBU,JONATHAN SHOW FACE FOR EKITI #tinubujonathanforekiti
As Governor election don almost shele for Ekiti,dem don begin campaign oo everywhere. APC dem go do deir own today for Oluyemi Kayode Stadium as dem wan put down Kayode Fayemi make he go be Governor for dem.Tinubu,Atiku and dem other ApC people go dey dere o.
PDP sef say we no go gree for d mata,dem sef say we must be Governor o. Dem put Ayo Fayose as dem own candidate o.Na inside Oluyemi Kayode stadium dey sef wan use but na tomorrow(Thursday) dem PDP wan do deir own talk talk. Presido Jonathan and Many PDP sef go dey dere oo..
Na dis one make dem Olopa dem carry many policemen for d state o. Dem even carry dem police people wey dey BOMB matter enta d state.Dem say dem no want make any gbegen shele..Even as dem PDP don point hand chuk inside APC eye say dem wan dagbaru d state o. Dem say APC dem don carry agbero con scatter deir campaign oo..Say dem don ready for dem as dem go show dem pepper...Ehh..Na wa oo...

OAU STUDENTS DEY PARA O #oaustudentsdeypara
Oau students dey para for dem school management o.Dem say dem no gree make dem increase school fee o.Students carry dem cardboard begin dey sing'we no go gree o' as dem block Ilesa-Ife expressway.
People wey dey drive car and bus begin dey beg d students make dem comot road o..Even police come follow dem talk,the students no gree comot oo.
Dem say dem increase new students school money from 17,000 to almost 100,000 and old students own from 7,000 to 50,000.The students shaa begin dey comot from 12 as some of dem get exam to go do o

GOBE FOR EBUTE-METTA,LAGOS #gobeforebutemetta
The Gobe wey shele for Ebute-Metta for yesterday (Tuesday) na die oo..It be like Season film wey no wan finish oo..Otto boiz as dem dey call dem scatter Ebute-Metta Yesterday o with gun. Dem just dey shoot everywhere.See as bullet dey fly like bird-Kai!
Mama Basira,Iya Uche,Oga Salisu and all d trader for dere sharpaly close dem shop ni oo.Dese boiz don dey trouble d area for almost two weeks now. Dem go enta person house go steal oo for daylight.If u no see anytin give dem,Dem fit kill u or make dem give una permanent damage for body oo.. Ngozi Braide wey b talk talk person for dem Olopa dem for Lagos say dem don make police people plenty for dere say everytin go soon die down oo.Say dem go show dem Otto boiz fire.We Pray say na wetin go happen be dat oo..

Tuesday, 20 May 2014
SOKA:POLICE ARREST THEM OGA O! #policearresrogasoka
Na d tin wey people wey dey Soka for Ibadan dey talk o. Soka na d place where dem dey take use people do ritual oo.Dem police don arrest some people but no b dem Oga oo..
People for dat place sef dey fear make agbero boiz no go turn d place to house.Dem wan make Government turn the place to market. D people sef wan make d Oga Ritualists dem Sleep for inside Prison o, say dem don too kill many people.

NAIJA FIT WIN WORLD CUP? #naijafitwinworldcup
Na dis question dem take sama Stephen Keshi wey be Naija Football Coach o. Dis question come when dem give am award as best coach for Naija o. Paul Bassey(Sport Analyst)and Refree Jelili Ogunmuyiwa sef collect award o.
Baba Keshi say hin thank Matchmakers Consult for the award oo. Keshi talk say na 1994 team still be best team for Naija bcos dem be get support of Naija people.
Hin Talk say na support and motivation dem need from Naija People, say dem fit win the world cup o.say people wey dey win am no get two heads o..He thank dem Naija people for dem Ogbonge support o..
Wetin Una tink about Wetin Keshi Talk o?

FOOTBALL AMEBO #footballtori
Omo many tinz dey shele for Football oo as season don finish oo..PSG dey target Eden Hazard wey dey Chelsea with all deir Power o...Dem wan catch dat boy by force.Even Arsenal sef get plenty Target like Milner wey dey Man City,Benzema wey dey Madrid and Even Mandzukic from Bayern Munich o. This one na say many players wan comot Arsenal o Like Sagna,Vermalean and even Fabianski.
As we continue the amebo,we also hear say Juventus dey target Patrice Evra say hin must come Italy oo..Even Drogba sef wan comot Galatasaray as Barcelona wan sell Fabregas,Mascherano,Song, Alexis oo.. New Man u coach sef don dey eye Van Persie like woman dey eye man.He wan use Van Persie do Captain oo.Dem don promise am plenty money sef to take buy players
As we continue the amebo,we also hear say Juventus dey target Patrice Evra say hin must come Italy oo..Even Drogba sef wan comot Galatasaray as Barcelona wan sell Fabregas,Mascherano,Song,
BUHARI-MY CHILDREN NO DEY STEAL! #mypikinnodeysteal
Gen Muhammadu Buhari don talk through Vanguard(Newspaper)say the boy wey EFCC arrest no be hin son o. This boy steal 20million Naira oo..Kai..see money.
The boy con dey bear Muhammed Buhari,Na so people begin dey call am Buhari child o. Baba Buhari don talk oo say hin no know d boy @ all oo. Hin say he no even dey related to am,say anytin wey EFCC wan do with am,Make dem go ahead jare.

NAIJA SEND SOLDIERS GO PEACE-KEEPING #naijasoldiersforpeacekeeping
For this April wey pass,Na Naija carry sixth for people wey send soldiers and police go fight Outside Naija. Naija send soldiers wey pass France,China,United Kingdom,Germany and Russia oo...
As Naija send 4,023 people go bring peace for Outside Naija,Our security people dem say enough people no dey to fight dem boko Haram oo..chai
As all dese tinz happen,Na so Oga Presido say all our security people dem begin to employ boku people oo to go wound dem boko Haram people oo before dem finish Naija.

Monday, 19 May 2014
Arsenal don win FA CUP - #ArsenaldonwinFACUP
Kai.Arsenal don win FA CUP oo after nine years wey trophy no dey.As match begin eh.Dem Hull city score two goals after eight minutes oo. In be like film trick for Arsene Wenger eye.
Fear catch baba but he maintain levels.He dey pray for hin mind make disgrace no shele o.Na so Carzola Score o,Baba Wenger mind begin dey bounce small small..Na So Koscielny sef score oo..Game con level.
Dem Arsenal boiz con dey play ball like say no tomorrow.dem wan win penalty by force,Refree no gree give dem o.Na so game enta extra time.D Arsenal Boiz vex ni oo..Dem just put d ball inside net like say na small boys dem dey follow play shaa...Field Scatter after whistle,Baba Wenger and hin player happy and dem hull city dey cry like akpos wey chop him baba cane finish.

GBEGE FOR REFINERY - #gbegeseleforrefinery
Gbege shele yesterday for refinery wey dey Port-Harcourt o.dem say one pipe do 'Gboko' like bomb when dem oil thief thief wan burst am.As fire start,na at least 7 people go meet baba God o.
Chairman for the Okirika Local Government wey d tin happen say NNPC dem na hin dey behind am oo.He come talk again say PPMC(Pipelines and Product marketing company)dey use the work play ten ten like small children.
Talk talk person for Police sef talk oo,She say dem hear d mata but no know how many people die o.As Oga Director for NNPC hear wetin Oga Chairman talk,he para o.Hin say hin no go reply am cos he fit use vex injure am with words.Say No NNPC worker die oo say na dem thief thief sef peme for d mata.

Sunday, 11 May 2014
Arrest President Jonathan #ArrestPresidentJonathan
Dem suppose arrest Naija President Jonathan Under Terrorism Prevention Act [Video dey]
Video link: https://www.youtube.com/watch?feature=player_embedded&v=mkuSLJLoITE">Video dey here
Dem details for report by dem Amnesty International,yarn say them Goodluck Jonathan government bin dey get informate about them Chibok terror attack and say them won carry them students, 4 hours before in happen, but them no respond to am, until dem attackers con reach the school 4 and a half hours after them don yarn say them dey go there, them military still no reach the village the village wey in happen until 8 hours after dem first give them informate, that na 3 am, na then the Kidnap people bin steal food and dem other things wey dem need from dem village. Come join the matter so, the Nigerian security department bin no dey there when the day don bright and them families wey get 200 knife and bow-and-arrow wey be civilian defense vigilantes wey get armed equipments, wey con ginger to go find the terrorists them and them kidnapped girls.
Military spokesman,wey be Gen. Chris Olukolade bin no deny them informate wey bin dey the Amnesty report, and say them army bin don receive plenty informate before in happen. Chris Olukolade bin yarn say na dem roadways and ambushes bin the things wey delay dem army, wey no allow them do something for the 5 hours wey con lead to the attack, and the three boku hours wey dem use for the school and wey dem take dagbaru the village.
Person wey dey yarn for them military bin no yarn why jets bin no follow them Terrorist people or why Helicopters, and why them no go use Bomb dagbaru the faces of them Terrorist before them reach Chibok, so that them no fit con attack them for the school. In no con yarn why them no tell the people wey dey the Village people make dem go hide. The General bin no con yarn why them poor community wey dem Nigerian Military no fit reach by road bin no get wetin dem Civilians wey dey the village get something we dem go fit Use Protect dem body.
NB: Dem details for event wey shele for April 14th, wey Amnesty International just tell them general public, no be new informate, in don dey available to them federal government security department tey tey since April 14th, the day wey the attack happen. Say President Jonathan government never fire the heads of security,say in no fit protect people life and in get criminal incompetence na in the report yarn so, say in don put President Jonathan for wahala so, say the act wey even con support terrorism for Nigeria.
President Jonathan bin go dance Alanta for in campaign rally, the day wey this Carry carry of them students happen, the day wey con follow the day after Nyanya terrorist bombing happen, wey pai 72 lives for Abuja.

President Goodluck Ebele Jonathan suppose dey arrested as in don fail to follow Law wey dey
"sections 4 (by supporting terror);section 7 ( by failing to deliver necessary information on terror); section 10 and 13 (by aiding in the financing of terror), of the Nigerian Terrorism Prevention Act, as amended."
This support of them terror suppose dey exhibited for them security service wey dey assist free flow of terror and abduction for Chibok, wey follow same pattern for many northern communities attacked, like Bama, Feb. 18, where the security department bin even help them terrorists when dem no reply for eight full hours. Shehu of Bama bin tell in citizens make them get guns, after them sack in town and in realize say the state security department wey dey under Goodluck Jonathan bin dey aid and bin dey bet the actions for dem terrorists wey dem no fit con secure in community.
Source: NewsRescue For English
Subscribe to:
Posts (Atom)

.jpg)