Thursday 22 May 2014

NO SCHOOL TODAY O-NUT #noschooltodayo

Omo,Nigerian Union Of Teachers(NUT) say no school for Naija today o.Dem say dem wan use today protest all over Naija.Dem say d Chibok girls mata don dey worry dem too much. Say dem no fit to keep quiet on top the Matter o.              
Dem President,Michael Olukoya talk say dem Bokoharam  don kill 173 teachers o.170 peme inside Borno and three inside Yobe. Hin con talk again say make Government dem dey protect student and dem teacher oo say make dis kin bad tin no shele again o.He con talk again say make dem give d family of d teachers wey don peme money o. God Help Naija o

No comments:

Post a Comment