Tuesday 20 May 2014

NAIJA FIT WIN WORLD CUP? #naijafitwinworldcup

Na dis question dem take sama Stephen Keshi wey be Naija Football Coach o. Dis question come when dem give am award as best coach for Naija o. Paul Bassey(Sport Analyst)and Refree Jelili Ogunmuyiwa sef collect award o.             
 Baba Keshi say hin thank Matchmakers Consult for the award oo. Keshi talk say na 1994 team still be best team for Naija bcos dem be get support of Naija people.  
 Hin Talk say na support and motivation dem need from Naija People, say dem fit win the world cup o.say people wey dey win am no get two heads o..He thank dem Naija people for dem Ogbonge support o..
Wetin Una tink about Wetin Keshi Talk o?

No comments:

Post a Comment