Thursday 22 May 2014

TINUBU,JONATHAN SHOW FACE FOR EKITI #tinubujonathanforekiti

As Governor election don almost shele for Ekiti,dem don begin campaign oo everywhere. APC dem go do deir own today for Oluyemi Kayode Stadium as dem wan put down Kayode Fayemi make he go be Governor for dem.Tinubu,Atiku and dem other ApC people go dey dere o.                                                       
    PDP sef say we no go gree for d mata,dem sef say we must be Governor o. Dem put Ayo Fayose as dem own candidate o.Na inside Oluyemi Kayode stadium dey sef wan use but na tomorrow(Thursday) dem PDP wan do deir own talk talk. Presido Jonathan and Many PDP sef go dey dere oo..                
Na dis one make dem Olopa dem carry many policemen for d state o. Dem even carry dem police people wey dey BOMB matter enta d state.Dem say dem no want make any gbegen shele..Even as dem PDP don point hand chuk inside APC eye say dem wan dagbaru d state o. Dem say APC dem don carry agbero con scatter deir campaign oo..Say dem don ready for dem as dem go show dem pepper...Ehh..Na wa oo...

No comments:

Post a Comment