Thursday 22 May 2014

BOMB FOR JOS #bombforjos

Dem Boko Haram bomb again for tuesday for Jos. Dem kill notin less dan 150people oo.For 3pm tuesday,One guy do like say hin tyre flat as hin cause hold up.People no know say na Boko Haram o.As Hold up dey,him just press one small button for d bomb,Na so him die with everybody wey dey d place o.          
 As people rush go help people wey wound for dere,Anoda bomb do'gbogbom' after 20minutes o..Ehh..See Confusion everywhere..         
 People dey run left,right,front,centre and back.Car wey wan do U-turn just dey burn anyhow cos of d fire wey comot from Bomb.Dem police and dem pana pana(fire fighter) reach dere shaa as dead body just full everywhere.                Presido Jonathan don talk shaa say hin no go gree for Boko-Haram make dem spoil Naija.Hin say dem wicked say him sef go show dem wickedness and Hin go kill all of dem soon.

No comments:

Post a Comment