Thursday 22 May 2014

OAU STUDENTS DEY PARA O #oaustudentsdeypara

Oau students dey para for dem school management o.Dem say dem no gree make dem increase school fee o.Students carry dem cardboard begin dey sing'we no go gree o' as dem block Ilesa-Ife expressway.                                
People wey dey drive car and bus begin dey beg d students make dem comot road o..Even police come follow dem talk,the students no gree comot oo.          
 Dem say dem increase new students school money from 17,000 to almost 100,000 and old students own from 7,000 to 50,000.The students shaa begin dey comot from 12 as some of dem get exam to go do o

No comments:

Post a Comment