Thursday 22 May 2014

DR GODWIN IWATT DON PAI #drgodwinpai

Kai..Dr Godwin Iwatt don pai oo.From d tori wey we hear,Na Dem cult boiz send am go meet Baba God o.Dis Dr Godwin na lecturer for University Of Calabar.Hin dey lecture Microbiology.                   
 Una no go believe say na inside hin office dem kill am oo.Eh..Dem don send letter to am two times to warn am o.As hin no con hear,Na so dem carry gun go meet am oo..As dem shoot am,dem just run comot.D lecturer peme after nine days o.                                                 
 Everybody for d skul dey fear now as police sef neva arrest anybody o.No lecturer wan gree to come class o.Kai..Chineke oo..Abeg helep o..

No comments:

Post a Comment