Monday 19 May 2014

Arsenal don win FA CUP - #ArsenaldonwinFACUP

Kai.Arsenal don win FA CUP oo after nine years wey trophy no dey.As match begin eh.Dem Hull city score two goals after eight minutes oo. In be like film trick for Arsene Wenger eye.                                  
Fear catch baba but he maintain levels.He dey pray for hin mind make disgrace no shele o.Na so Carzola Score o,Baba Wenger mind begin dey bounce small small..Na So Koscielny sef score oo..Game con level.                                  
Dem Arsenal boiz con dey play ball like say no tomorrow.dem wan win penalty by force,Refree no gree give dem o.Na so game enta extra time.D Arsenal Boiz vex ni oo..Dem just put d ball inside net like say na small boys dem dey follow play shaa...Field Scatter after whistle,Baba Wenger and hin player happy and dem hull city dey cry like akpos wey chop him baba cane finish.

No comments:

Post a Comment