Sunday 11 May 2014

Arrest President Jonathan #ArrestPresidentJonathan


Dem suppose arrest Naija President Jonathan Under Terrorism Prevention Act [Video dey]

Dem details for report by dem Amnesty International,yarn say them Goodluck Jonathan government bin dey get informate about them Chibok terror attack and say them won carry them students, 4 hours before in happen, but them no respond to am, until dem attackers con reach the school 4 and a half hours after them don yarn say them dey go there, them military still no reach the village the village wey in happen until 8 hours after dem first give them informate, that na 3 am, na then the Kidnap people bin steal food and dem other things wey dem need from dem village. Come join the matter so, the Nigerian security department bin no dey there when the day don bright and them families wey get 200 knife and bow-and-arrow wey be civilian defense vigilantes wey get armed equipments, wey con ginger to go find the terrorists them and them kidnapped girls.
Military spokesman,wey be Gen. Chris Olukolade bin no deny them informate wey bin dey the Amnesty report, and say them army bin don receive plenty informate before in happen. Chris Olukolade bin yarn say na dem roadways and ambushes bin the things wey delay dem  army, wey no allow them do something for the 5 hours wey con lead to the attack, and the three boku hours wey dem use for the school and wey dem take dagbaru the village.
Person wey dey yarn for them military bin no yarn why jets bin no follow them Terrorist people or why Helicopters, and why them no go use Bomb dagbaru the faces of them Terrorist before them reach Chibok, so that them no fit con attack them for the school. In no con yarn why them no tell the people wey dey the Village people make dem go hide. The General bin no con yarn why them poor community wey dem Nigerian Military no fit reach by road bin no get wetin dem Civilians wey dey the village get something we dem go fit Use Protect dem body. 
NB: Dem details for event wey shele for April 14th, wey Amnesty International just tell them general public, no be new informate, in don dey available to them federal government security department tey tey since April 14th, the day wey the attack happen. Say President Jonathan government  never fire the heads of security,say in no fit protect people life and in get criminal incompetence na in the report yarn so, say in don put President Jonathan for wahala so, say the act wey even con support terrorism for Nigeria.
President Jonathan bin go dance Alanta for in campaign rally, the day wey this Carry carry of them students happen, the day wey con follow the day after Nyanya terrorist bombing happen, wey pai 72 lives for Abuja.
President Goodluck Ebele Jonathan suppose dey arrested as in don fail to follow Law wey dey 
 "sections 4 (by supporting terror);section 7 ( by failing to deliver necessary information on terror); section 10 and 13 (by aiding in the financing of terror), of the Nigerian Terrorism Prevention Act, as amended."
This support of them terror suppose dey exhibited for them security service wey dey assist free flow of terror and abduction for Chibok, wey follow same pattern for many northern communities attacked, like Bama, Feb. 18, where the security department bin even help them terrorists when dem no reply for eight full hours. Shehu of Bama  bin tell in citizens make them get guns, after them sack in town and in realize say the state security department wey dey under Goodluck Jonathan bin dey aid and bin dey bet the actions for dem terrorists wey dem no fit con secure in community.
Source: NewsRescue For English


No comments:

Post a Comment