Thursday 22 May 2014

GOBE FOR EBUTE-METTA,LAGOS #gobeforebutemetta

The Gobe wey shele for Ebute-Metta for yesterday (Tuesday) na die oo..It be like Season film wey no wan finish oo..Otto boiz as dem dey call dem scatter Ebute-Metta Yesterday o with gun. Dem just dey shoot everywhere.See as bullet dey fly like bird-Kai!                                        
  Mama Basira,Iya Uche,Oga Salisu and all d trader for dere sharpaly close dem shop ni oo.Dese boiz don dey trouble d area for almost two weeks now. Dem go enta person house go steal oo for daylight.If u no see anytin give dem,Dem fit kill u or make dem give una permanent damage for body oo..              Ngozi Braide wey b talk talk person for dem Olopa dem for Lagos say dem don make police people plenty for dere say everytin go soon die down oo.Say dem go show dem Otto boiz fire.We Pray say na wetin go happen be dat oo..

No comments:

Post a Comment