Thursday 22 May 2014

NA WITCH? #nawitch

Na God save am,dem for kill am oo..Who?  Well,na one woman wey dem see for Ojo road,Ajegunle oo. People say na witch o, say she dey fly for inside sky oo..                                                           
 Some say dem see three bird for inside sky o,Say na so one land for road and turn to d woman. D woman don reach like 80 years o.Dem wan begin dey beat d woman oo until Baale for area call police o. D Baale say hin no believe say na witch o.Say some old people Brain don turn to small pinkin bcos of dem age.                                                  
 Even as dem carry her reach police station,plenty people still reach dere say dem wan beat her oo..Fear sef catch police when dem see plenty people.kia kia dem call other police station wey close.Na tear gas wey dey pepper eye dem take send d people comot o..Kai...U tink say Na witch true true?

No comments:

Post a Comment