Tuesday 20 May 2014

FOOTBALL AMEBO #footballtori

Omo many tinz dey shele for Football oo as season don finish oo..PSG dey target Eden Hazard wey dey Chelsea with all deir Power o...Dem wan catch dat boy by force.Even Arsenal sef get plenty Target like Milner wey dey Man City,Benzema wey dey Madrid and Even Mandzukic from Bayern Munich o. This one na say many players wan comot Arsenal o Like Sagna,Vermalean and even Fabianski.      
 As we continue the amebo,we also hear say Juventus dey target Patrice Evra say hin must come Italy oo..Even Drogba sef wan comot Galatasaray as Barcelona wan sell Fabregas,Mascherano,Song,Alexis oo.. New Man u coach sef don dey eye Van Persie like woman dey eye man.He wan use Van Persie do Captain oo.Dem don promise am plenty money sef to take buy players



 

No comments:

Post a Comment