Monday 19 May 2014

GBEGE FOR REFINERY - #gbegeseleforrefinery

Gbege shele yesterday for refinery wey dey Port-Harcourt o.dem say one pipe do 'Gboko' like bomb when dem oil thief thief wan burst am.As fire start,na at least 7 people go meet baba God o.        
  Chairman for the Okirika Local Government wey d tin happen say NNPC dem na hin dey behind am oo.He come talk again say PPMC(Pipelines and Product marketing company)dey use the work play ten ten like small children.       
 Talk talk person for Police sef talk oo,She say dem hear d mata but no know how many people die o.As Oga Director for NNPC hear wetin Oga Chairman talk,he para o.Hin say hin no go reply am cos he fit use vex injure am with words.Say No NNPC worker die oo say na dem thief thief sef peme for d mata.

No comments:

Post a Comment