Monday 26 May 2014

FIGHT FOR EKITI O. #fightforekiti

Na After dem Labour Party finish dem campaign o for Ikere-Ekiti, Agbero boiz carry demselves come d place o.  Dem carry bottle,cutlass,axe even gun sef.Dose boiz begin dey attack all d people dem see o for d campaign place. Even AIT cameras sef suffer am as dem kidnap  am  oo.                                
     Dis one shele wen d Oga dem for d Labour Party don comot d place with Olopa o.Dem Labour Party say Na APC people do dis wicked tin oo.Dem APC sef don talk say Na Labour Party attack dem APC o,say Na even APC member dem shoot o.                                              
     D Olopa for d place don collect d motor wey d agbero bring come o,Na APC name dey d body.(Olopa)Police don Say dem go catch all d agbero boiz oo wey spoil many tinz for d place dat day. Who Make we believe now o?

No comments:

Post a Comment