Thursday 29 May 2014

WE NO FIT BRING CHIBOK GIRLS FOR NOW-NAIJA MILITARY #naijamilitarygirls

Na dem Naija Military talk dis one oo..Dem say d tin no be small mata o.Say dose girls dey inside forest where dem Boko People keep dem.                             
   Na Alex Badeh follow dem tori people talk o say dem don know where the girls dey o.Hin con talk again say dem no fit use agidi(force) go d place o.                  
  Hin say dem fit go kill d Chibok girls if dem use agidi with Boko Haram.This kin talk don even Vex presido Jona as we take hear o.Presido as we hear dey tell people say Alex no suppose talk dis kin tin to the world,say na secret sumtin.wetin una think my people?

No comments:

Post a Comment