Thursday 22 May 2014

NAIJA IMMIGRATION GBAB COCAINE DEALER #demcatchcocainedealer

Ehhh...Cocaine Dealer get sense oo..Dem Gbab one man for airport wey hin name na Onyejiaju Augustine.The man carry cocaine put inside sweet oo..   Dem olopa wey dey airport(immigration) get plenty equipment o.As dem take test the packets of sweet dem,na so d machine begin dey make sound o say hin don catch thief.                                       
  Dem say Na Brazil d man dey come stay, even tho say na Imo-state hin papa come from.D matter don become big sumtin o..Dem don even carry d mata go court..

No comments:

Post a Comment