Thursday 29 May 2014

STUDENTS FOLLOW POLICE FIGHT #studentfightpolice

Gbege shele yesterday for Lagos o.Students wey dey Yaba College Of Technology and Federal College Of Education,Akoka follow police fight o. Many people just wound for the fight but the students sef spoil water corporation and LAWMA(Lagos Waste Management Authority) motor oo.                                   
 This one shele wen students dey shout 'we no go gree oo',dem say make dem government call off dem strike o.Dem wan carry am go third mainland bridge o.Police no wan make dem go,na so dem overtake dem bus shaa.Dem begin dey shoot teargas oo..                                                          
 This one make student eye red like blood.Dem carry bottle and stick as police sef dey pursue dem up and down.Na hold-up this kin tin cause oo.Abegi government make these students go back skul oo..

No comments:

Post a Comment