Monday 26 May 2014

JOS:BOMB AGAIN Ooo.. #josbombing

Na for Saturday oo dis one shele for Jos again oo..One guy wey be Suicide Bomber na hin kill 3people o. Na like 400people hin wan kill before o but Baba God no allow am.                                                   
  As people dey watch ball dey jollificate,one guy dey carry car about, wey get bomb inside o. Hin wan carry d car enta d place wey dem dey take watch ball gan gan.                                   
  He con look oo...No way him fit enta oo..Na wetin make am park for front of one house o. Na so one of dem people wey dey stay d house tell am to comot o..As d guy dey enta car,na so d bomb do 'gboom' and kill 3people for dere o.

No comments:

Post a Comment