Monday 26 May 2014

CHAMPIONS LEAGUE:REAL MADRID FLOG ATHLETICO MADRID #realatheletico

D Match wey Shele for Saturday For Lisbon,Portugal no be small tin o.Na Final match for d football cup wey
UEFA dey call Chamions League oo.Na Athletico Madrid follow Real Madrid Play o.             
    As match dey continue for first half,Na so Real Madrid keeper do mistake o.Athletico quickly score ni.Dem no waste time rara.Ehh..Real Madrid dey try score o,Dem even Over-waste Chance o.             
 When 90minutes reach,Na Athletico Madrid still dey lead o. Dem con give 5minutes make dem take play oo..As 93minutes reach,na so One Real Madrid person-Sergio Ramos use head put ball inside net o.Game change,1-1 oo..          
   See as everywhere dey hot for inside the field. Everybody mind just dey high o.Na so game enta extra time.dem play first half finish,notin oo..As dem enta second half lasan,Na so Gareth Bale use head score again For Real Madrid o..               
    Before una go say yeepa,Marcello don score d third one o as Ronaldo sef put hin own join.Everytin turn to 4-1. Athletico Madrid players eye red pass blood,deir coach sef wan beat Refree. No b small mata oo..Na so Real Madrid take carry deir No 10Champions League cup o.

No comments:

Post a Comment