Thursday 29 May 2014

THIEF KILL POLICE,BANK MANAGER FOR RIVERS #bankmangerpolicepaiforrivers

Thief Thief people kill Regional Manager of bank and four police oo.This one shele for early momo(9:45)am wen d Manager and d olopa(police)dey carry plenty money go anoda place o.                        
 The Thief Thief people hide for somewhere. As dem see say d motor wey carry Manager and Police show,dem begin dey shoot.                                       
  This gun pass wetin person fit to talk about.Na die oo.Dem just fire all d car oo.dem kill all d olopa wey dey dere and d manager.Even d only Olopa wey take style escape,one bullet meet am for body.Na wa oo..God help us o.

No comments:

Post a Comment